Naija :FA Draw go hold for Abuja


The Naija football federation (NFF) wey na dem dey control all de football matta for Naija don tok say na Thursday be de day wey dem go do de draws for de 2013 FA cup and na for de National Stadium dem go do am for Abuja.
Na de NFF Director of competition, Mohammed Sanusi na him kon yarn plenty amebo people like we for supersport.com dat na 63 clubs go dey involve for dis year FA cup for Naija.
Walahi, Yobe State no register any club for dis ogbonge competition for Naija, while Ranchers Bees of Kaduna fit crash kommot if dem no pay de N200, 000 gbese wey dem dey owe before Thursday morning.
“The oga dem wey dey control Ranchers Bees don dey fall dia hands as dem never pay dia fine wey we nack dem for late registration since last year and we don kumma tell dem dat tomorrow morning (Thursday) na hin be de last day for dem,”. Sanusi tok.
Na all de 20 clubs wey dey campaign for de Naija Professional Football League (NPFL) plus de 22 clubs wey dey for de Naija National League (NNL) go participate for dis year federation cup.
Nine clubs from de National League go also take part for de competition while 12 clubs wey na for street dem dey play dia ball jeje go also jam with de big boys.
NFF also don take style add Women own to dis year draw, but na 22 clubs go participate for dia own side.
Ogbonge Naija League club, Heartland na dem be de current Baba for de Men FA cup in Naija, while Rivers Angels be de champions for de Women.

Comments

Popular posts from this blog

Fiorentina Veteran Luca Toni Says Stevan Jovetic is not loved