Wata Pass Garri for AC Milan Match



 
AC Milan eye dey ontop Champions League nes season, but e get as e be, afta Sulley Muntari bin colet red card and dem come follow AS Roma play 0-0 draw on Sunday, for match wey refree stop small sake of say de oyibo fans dem bin use bad language cuss black playa.
Na Roma bin waka come Milan stadium and dia skippo, Francesco Totti bin colet red card afta hin elbow playa, for inside match wey turn guymen belle, sake of say Roma fans dem bin dey use bad language cuss Mario Balotelli, sotay, match stop for one minit sef.
Fiorentina dey shadow Milan for third position afta dem waya Palermo 1-kondo. Palermo don relegate comot for Serie A sha, for season wey dem use three diffrent coachi; two of dem two tines sef.
Siena sef follow dem relegate, afta Napoli waya dem 2-1, to join Pescara wey don wka comot Serie A too.
Genoa follow Inter Milan (dia whole team dey hospital now sef) play 0-0 draw and Torino foloow Chievo play 1-1 draw as dem manage waka comot for relegate position.
Top goal scorer for Seria A, Edinson Cavani na im fes score for Napoli meaning say he don score 28 goal dis season.
Napoli don alredi colet second position for league, for Juventus back, and dem go play Champions League nes season.
Meanwilly, na Antonio Di Natale score de two goal wey Udinese (dem dey fifth position) take waya Atalanta 2-1, as dia eye dey ontop Europa League and Lazio dey shadow dem sef, for six position, afta dem waya Sampdoria 2-1.
Milan dey fin how dem go finish for third position for league table, to confam Champions League nes season, and dem bin dey fin win wen dem follow Roma play, but afta 40 minit of sweet futbal, e jus be like say Muntari chop winch.
De guyman bin colet yellow card, come go carri vex jack refree hand, as Milan playa dem dey raise dust. Refree jus vex dash am red card.
DEM CUSS BALOTELLI
Na Milan get short one, but na Roma dey play defence, and na so dem play second haf sef, as de match come dey turn rough play.
Refree stop de match small, as second haf start, sake of say Roma fans dem come dey cuss Milan strika, Mario Balotelli.
As na de way Italy Futbal Federation and Italy govment pipu don tok, Milan come use microphone take warn de fans dem, bifor match continue.
E bin be like say Roma for get penarity sef, wen kevin Constant carri leg put for Erik Lamela inside 18, but refree no see am, bifor Totti come colet hin red card.
Milan don gada 69 point from 37 match and Fiorentina get 67 point.
De two of dem go travel go play bottom table team nes weekend, as Milan go play Siena and Fiornetina go follow Pescara play.
If de two of dem finish bracket-bracket, Fiorentina go colet third position bicos na head-to-head dem dey use for Italy.
Palermo, Genoa and Torino match dem, bin start late bicos of kwarel wit bicycle competition pipu (na Giro D'Italia dem dey call de competition.). /p>
Local govment pipu for Florence (na town for inside Italy) bin tok say de Fiorentina match musto start for 12.30 (Italy time) so dat dem no go disturb de bicycle pipu wey go enta de town for afternoon.
But Palermo presido, Maurizio Zamparini, come voke say dem sef no go play dia own unless Genoa and Torino match sef start de same time, and Serie A oga dem come gree.
Forma Palermo playa, Luca Toni na im score de onli goal as haf time wan reach, and Palermo jus enta one chance, sake of say heavy rain come make fild be like River Niger.
Palermo begin dis season and finish am wit Giuseppe Sannino as dia coachi, afta dem bin sack wen season start, carri Gian Piero Gasparini come.
Dem sack Gasparini for February, carri Alberto Malesani come be coachi, but dem sack dat one afta three match, come carri Gasparini come again.
Gasparini sef no last again, and na so dem sack afta two match bifor dem come bring Sannino come back.

Comments

Popular posts from this blog

Fiorentina Veteran Luca Toni Says Stevan Jovetic is not loved